Skip to main content

 

Jeff Bezos: Andy Jassy be CEO of Amazon as Jeff Bezos step down - See di Amazon founder next move

Jeff Bezos: Andy Jassy be CEO of Amazon as Jeff Bezos step down
Wetin we call dis foto,

Jeff Bezos, age 57, don dey lead Amazon since e start as an online bookshop in 1994.

Amazon founder Jeff Bezos announce on Tuesday say im go e step aside as Chief Executive Officer [CEO] of di online retail giant to serve as executive chairman.

Jeff Bezos na Andy Jassy, Amazon cloud computing business oga, go replace am as CEO.

Oga Bezos tok say dis move go give am more time to focus on im oda "passions.

"I go stay engage in important Amazon initiatives but also get di time and energy I need to focus on ... my oda passions. I neva get more energy, and dis no be about about retiring. I dey super passionate about di impact wey I think dis organizations fit get," di Amazon founder tok.

What next for Jeff Bezos afta e step down as Amazon CEO

Wetin we call dis foto,

Jeff Bezos

As some pipo all ova di world dey wonder wetin dey next for Jeff Bezos, here na di tins oga Bezos say im go dedicate e time to;

  • For di Tuesday letter to Amazon workers, oga Bezos tok say im go use im new free time to focus on di Day One Fund, di $2 billion fund e establish for 2018 with di aim of opening full-scholarship, Montessori-influenced preschools for underserved communities and fund nonprofits wey go support homeless families.
  • E also tok say e go work on di Bezos Earth Fund, wey im kick off one year ago with $10 billion pledge (almost 10% of im net worth at di time) to fight against climate change by giving grants to "scientists, activists, NGOs—any effort wey offers a real possibility to help preserve and protect di natural world," Bezos tok.
  • Bezos also also get Blue Origin, im private spaceflight company, wey dey develop rockets for commercial space tourism wey e say fit help NASA take humans to di Moon.
  • Oga Bezos tok say e also dedicate more time to di Washington Post, wey e buy for $250 million in 2013, and help to expand di digital presence and ramp up revenue.

Jeff Bezos found Amazon, wey e start as an online bookstore, for 1994 out of im garage for Seattle.

Now Amazon na one of di biggest companies for di world, and operates oda business in streaming, entertainment, groceries, delivery and more. Oga Bezos worth $196.4 billion, according to Forbes.

Amazon announce on Tuesday say Bezo go step down as CEO and Andy Jassy, wey dey lead Amazon Web Services go replace am.

Comments

Popular posts from this blog

Click to watch the commanding day

Musk announces free premium features for users with over 2,500 verified followers

  Those with over 5,000 verified followers will be able to enjoy Premium+ free of cost Read more below: Elon Musk, the billionaire owner of the X platform, formerly Twitter, on March 28 announced that accounts with more than 2,500 verified followers will get premium features for free. Those with over 5,000 verified followers will be able to enjoy Premium+ free of cost. “Going forward, all X accounts with over 2500 verified subscriber followers will get Premium features for free and accounts with over 5000 will get Premium+ for free,” he said. This marks yet another shift for the social media platform under Musk, rewarding high-engagement users and fostering a more vibrant creator ecosystem. The platform provides various features in the Premium and Premium+ categories.

Titanic 2 is back

Titanic 2 -The return of Jack 2021 movie trailer Watch it here : https://youtu.be/5A6YjRSvR0Q