Skip to main content

 

Sunday Igboho storms Ogun State: Sunday Adeyemo move to flush herdsmen in Ogun no be goment invite am

Sunday Igboho storms Ogun State:
Wetin we call dis foto,

Sunday Igboho tok to youths for Ogun state

Sunday Igboho [Sunday Adeyemo] wey storm Ogun State to flush out herdsmen, no be goment invite am, di goment don clear di mata as e dey hot inside di Yoruba speaking state inside southwest Nigeria.

Ogun State Commissioner for Information and Strategy, Abdulwaheed Odusile, dismiss di report inside one statement inside Abeokuta hours after Igboho land di state.

Oga Odusile say di report from one interview Remmy Hazzan, di special adviser on public communication to Governor Dapo Abiodun, dem quote out of context.

"Dem twist di interview to achieve sensational effects.

"inside di interview, Hazzan say di state government, for dia usual approach to governance, go continue to work wit all di stakeholders, both within and outside the state to ensure security of lives and property.

Di Ogun State Commissioner explain say dem twist di mata to mean say di state na im invite Mr. Adeyemo (Igboho) to help curb insecurity.

"Dis tori dey totally misleading.

"Di Dapo Abiodun-led Administration, since inception, don dey known to be inclusive inside all dia approach, collaborating and engaging wit a wide range of stakeholders including security issues.

[Sunday Igboho storms Ogun State] - Background

Sunday Adeyemo aka Sunday Igboho address youths for Ogun state on Monday as e enta bush to go draw ear for herdsmen wey dey di state.

Plenti pipo gather for Ogun state on Monday to meet wit di Human right activist, Sunday Igboho wey give herdsmen ultimatum to comot from Yoruba lands.

In di past week, im bin give herdsmen for Oyo State, wey be im home state seven days deadline to leave di state on top accuse of Kidnap, rape and killings of farmers and pipo for di state.

On Monday Sunday Igboho carry di campaign to pursue di herdsmen from yoruba land enta Ogun State.

Comments

Popular posts from this blog

Click to watch the commanding day

Musk announces free premium features for users with over 2,500 verified followers

  Those with over 5,000 verified followers will be able to enjoy Premium+ free of cost Read more below: Elon Musk, the billionaire owner of the X platform, formerly Twitter, on March 28 announced that accounts with more than 2,500 verified followers will get premium features for free. Those with over 5,000 verified followers will be able to enjoy Premium+ free of cost. “Going forward, all X accounts with over 2500 verified subscriber followers will get Premium features for free and accounts with over 5000 will get Premium+ for free,” he said. This marks yet another shift for the social media platform under Musk, rewarding high-engagement users and fostering a more vibrant creator ecosystem. The platform provides various features in the Premium and Premium+ categories.

Titanic 2 is back

Titanic 2 -The return of Jack 2021 movie trailer Watch it here : https://youtu.be/5A6YjRSvR0Q